...

6 views

WHERE IS MY DESTINY HELPER 😭
DESTINY HELPER!🔥
DESTINY HELPER!! 🔥🔥
DESTINY HELPER!!! 🔥🔥🔥

Oh GOOOOOODDDDDD!!! MY DESTINY HELPER 😭 😭 😭
Lord distract, attract, bring them, give them sleepless night,let them locate me...and what again. 🤔

Aunty you prayed well o
Uncle you sabi kabash

But do you know you are somebody's DESTINY HELPER 🤔
"But I don't have money nah"
" wetin I wan com give person"
"No be person wey chop dey help person"

Are you serious? 😲
So you no get money eh 😼
You no know wetin you go give person 🤔
You never chop for your life 😲
Chim o!
Anty why 😔😯😼
Uncle you too 🤔

Anty the cloth wey plenty for wardrobe u never wear since January. You want use am do dorime 🤔
"Tufiakwa! I no fit give person my cloth make them carry am give dibia." 😼
So that cloth wey you buy month end, u see the person wey sew am tell am say make nobody wear am till you buy am abii 😼
Okay make we leave cloth mata
The data wey you don buy last week alone nah somebody's medicine money o
You no fit give somebody N100 as give away
Aunty why 🤔
Uncle you too dey follow complain.
You dey buy dey give woman but your sister they ask for money for school fees since, pocket money sorry transport money you say you no get.
Okay make we leave money mata
You no fit share or help anybody wey you know or wey you no know but you dey SHOUT DESTINY HELPER LOCATE ME.

Shebi we know this golden rule:
"DO TO OTHERS WHAT YOU WOULD LIKE OTHERS TO DO TO YOU" 🤔
E still dey work o

Friends, lets spread the love of God to everyone around us
You and I are somebody's answered prayers.
You and I are somebody's DESTINY HELPER o


#change #helpingothers #act
Dera Soars

© Nwankwere Chidera