...

9 views

TABLE GO TURN ( A PIDGIN WRITUP )



When you turn look wetin dey Happen around you..

Your mind go dey tell you say your own don finish.

People wey sorround you go use mouth finish you say

"Nothing come out , we don see you finish,"

"Your life no go fit beta, e no go fit change."

You sef you don use bad mouth counterbalance your life,

You don carry your own mouth talk nonsense about your own life .

You don even ask God say

"Baba God I Know sey village people dey exist,

But na only me get village people?, Na only me Dem do?"

"Why my own come dey like dis na?"

You don see small children dey do anyhow ,

Dem dey form as if na deir papa get the world,

But e get one thing wey you and those rich men children no know.

Baba God just dey look down , dey look you and

E don send me come tell you sey ...

TABLE GO TURN...

One day surely surely dis world table go turn for your good.

Baba God talk am sey as far as you dey alive na mean sey,

You get something wey we dey call HOPE,

Na only person wey dey alive go fit hope for the day ,

Wey table go turn reach am...

Your life no end here oh , dis part na your trial part,

This na hardship time,

this na the story wey you go tell your children

Your enjoyment part dey road dey come,

your fufillment part dey come.

Abi na your family members dey decieve you sey,

"For this our family, person no dey succeed, person no progress,

Person no dey move front at all"

"Everybody dey stagnant for one point".

But baba God don send me come tell you sey ,

The correct answer wey you suppose give Dem na say,

"Na me go break record,

Na me go break the law of gravity for this family".

"Na me go change protocol for this family."

"Na me go change the story of this our family.."

If you no understand wetin I don talk since just understand sey TABLE GO SOON TURN for your sake and for your good

And you go finally smile come nod your head with pride...

©Peace Philip's